Talent & Effort

  • 59
  • 4
  • 0
  • 4
  • 3
  • 0

This poems talk about adding efforts to your talent.

Lyrics

Brother Man!
No go let Dem whine you o,
Say talent alone is enough.
Because even for Naija, talent no dey ring bell.
You fit sabi pass, but if you no hustle,
You go dey carry last, no cap!!

Abi you no hear? Talent na raw gold,
But without hammer and sweat,
E go remain cold. You no understand?
Talent na gift, but gift wey dem no unwrap, na waste.
Talent na gift, but gift wey dem no use, na load.

No be juju, na effort dey run am.
Talent na bicycle; hard work na the chain.
Talent fit open door, but na hustle dey carry you enter.
Dem no go dash you success like free amala for party.
Talent na just seed, but na you go water am grow?
Na sacrifice dey build super star wey the world dey hail.

Brother Man!
No go let Dem whine you o,
Say talent alone is enough.
Talent na raw soup ingredient;
You go still cut, grind, and cook am well.
Because if you serve half-done stew,
Even hunger go reject am.

No be say breeze blow Messi reach where e dey,
Or Burna Boy just wake up dey win Grammy.
Na sweat, na sacrifice, na days of no sleep.
Because talent fit be ladder, but na effort dey make you climb.

So, my people, make we talk true.
For this Naija wey street be king,
Na sweat and grind dey make talent win!
Talent na starter pack, but na effort dey finish game.
No go dey look person glory say, "E easy!"
Because success no dey free like Lagos traffic insult.

Dear poets, you get the talent,
But you no dey practice,
Dey wait make destiny locate you.
No dey whine yourself.
Destiny no dey use GPS.

TALENT ALONE IS NOT ENOUGH!
GET YOUR HANDS DIRTY

talent alone is not enough

00:11

pidgin poetry

00:41

we go again.

::
/ ::

Queue

Clear